音效
界面
难度等级
口音
界面语言
1
和/或在社交方面支持我。网络:
Illusions
(专辑: Theta - 2022)
You carry boyi go yonder, you say he no go oh Slavers boku round town hin brother tell am oh Stand for your ground, make you no hurry follow go Them dey sell people troway, my brother no go oh The
people them wey go river never return oh Them say na mami water carry everybody go oh For full moon, papa go farm he never return oh Them say na the
forest carry am swallow oh Listen boyi, life no balance at all oh You go place you no know, you no go return oh Boyi feeling true, him heart dey beat for the
road oh Him fate na to follow them, follow journey go ah Ah ah ah ah ah Wetin I
think I
become ah Ah ah ah ah ah Na illusion them dey sell you so ah Boyi look forth, him look out, no other place to go oh He carry him few belongings, reluctantly follow go For this life we dey, the
thing you do you know oh E
better to go reach the
place find how e
dey oh I
talk am, I
shout am boyi still dey travel go Na destiny dey push man where him dey go ah He try am, he fight am, urge strong no be small The
tori e
dey the
place where him dey go ah Ah ah ah ah ahh Na wetin I
think I
become ah Ah ah ah ah ahh Na illusion dem dey promise you so ah Oga master no wan know value pig pass people oh He say dem be property, with him dog dem equal oh Boyi clean gun, he shave beard, Oga trust no other He for adopt boyi, but him people hala That night boyi take razor he shave am proper The
way Oga dey like am, no touch him moustache ah Poison for soup, for family and the
guards them He slash master throat too from ear to ear ahhh Ah ah ah ah ahh Boyi na most wanted for strange country ah Ah ah He dey gather soldiers ah From plantations he dey break boys free ahhh Ehn ehn My people The
main reason we gather here today, na him ehn, na him concern us now Na there we dey go next Ah today on behalf of the
people of the
city and the
township, the
entire tribe and our very very race, we go unveil this statue of boyi We go give our honorable personality himself the
scissors to use cut the
ribbon For service to humanity and to race and eh we salute you sir We salute you well well, because you really don touch our lives, you don change our lives from generations to generations to come Nothing go ever remain the
same for us Yes, this statue na the
honor of your greatness and service Thank you
完毕